28/04/2026
**My Pregnancy Disaster with One “ Sew with Ijeoma ” YouTube Graduate 😭💔**
Last year, when pregnancy had turned me into a walking zombie — weak, sleepy, and always hungry — I desperately needed help in my small shop.
Then one day this sharp babe entered my DM like she was applying for Google:
**Her:** Good afternoon aunty 😊
Aunty please I just finish fashion school. I dey find place do my IT. Abeg can I come help you for free? I sabi work well well.
Me, with belly like drum and zero energy, quickly typed back:
**Me:** My sister welcome o! Come start tomorrow morning. God bless you.
The next day she resumed looking fresh, smelling nice, phone in hand like she’s about to vlog the whole experience.
I had just cut one customer’s dress — very urgent order. I told her:
**Me:** See this skirt, just join the sides for me make e neat. Simple straight stitch.
But then I looked at my own maternity fabric that my friend Ugwu Favour had given me with love (6 full yards of beautiful ankara o!). I thought, “Ah-ah, let me use this opportunity to sew something nice for myself before this baby comes out.”
So I changed my mind and said:
**Me:** Wait wait… forget that customer skirt. Take this one. I want A-line short maternity gown. Nothing complicated. Just make am fine abeg. You fit do am?
**Her:** (smiling like she invented sewing machine) No wahala aunty. I go scatter am!
Me, feeling very pregnant and very trusting, went to lie down small. “Make I rest my back 15 minutes before this baby starts kicking like footballer.”
I woke up like 3 hours later to find… fabric massacre on the table 😭
Threads everywhere. Pieces cut in shapes that even God cannot recognize. One sleeve long like agbada, the other short like crop top. The front and back no dey even relate. 6 yards gone. Vanished. Wasted.
I almost started crying blood.
**Me:** (voice shaking) My sister… wetin be this? 😭
**Her:** (calm like she just finished masterpiece) Aunty na the style I dey see for head o.
**Me:** Which style?! You cut this kain thing?! Where did you even learn sewing?
**Her:** (proud face) Sew with Ijeoma.
**Me:** (eyes wide) You mean the big Sew with Ijeoma academy? That one wey everybody dey praise up and down?
**Her:** Yes o!
**Me:** And this is what they taught you?! To turn 6 yards into tissue paper?! I go report you to your madam make she withdraw your certificate sharp sharp!
**Her:** (quiet voice) Aunty… I no get certificate.
**Me:** Ehn?! 😳 How?!
**Her:** I no do final project.
**Me:** Okay… but how come you dey do IT now?
**Her:** I do 2 years course.
**Me:** 2 years?! Which school dey give 2 years course for IJ? Sew with Ijeoma no dey do 2 years na!
**Her:** (looking down) Na… na YouTube version I do.
**Me:** JESUS CHRIST OF NAZARETH! 😱
You mean you watched video for 2 years and you come here to use my 6 yards as YouTube practical?!
Ogini bu ifea?! Ọ bụ mme mmụọ?!
I just looked at her, looked at the ruined fabric, looked back at her… then I said very calmly:
**Me:** My dear… please pack your bag. Go home. Don’t come back here again unless you wan pay me money to train you from zero. Abeg comot for my shop before pregnancy vex catch me.
She left quietly.
My real pain now is that this fabric was gift from my sweet friend Ugwu Favour. The one wey dey always support my hustle. I never even thank her properly before e turn casualty of YouTube fashion school.
Ugwu Favour if you dey see this abeg forgive me 😭
Bikonu find small mercy for your girl… another 6 yards go do am o! Just dash me small love again 🙏🏾
And to all the real Sew with Ijeoma students — una too sabi work abeg no vex 😂
But this particular YouTube department… na war crime 😭
Justice for my 6 yards!
Justice for Sew with Ijeoma real graduates!
Justice for pregnant women who trust strangers with fabric! 🙌
Who else don suffer YouTube tailor before? Make una talk abeg 😩