21/04/2026
Men be like “My mother is a very strong woman.. Since my father d!ed, she sold groundnut and trained me and my 4 siblings till university level”. Some will even say “My mum roasted corn, and single-handedly trained me and my 6 siblings till university level”
But when they see a girl in today’s generation who are Hair vendors, Hairstylists, Nail techs, Lash techs, Chefs, buy car or even get a well furnished apartment, they will say “Na lie, she dey do H00kup, na sugar daddy dey give am money, na cl!tocurrency she dey trade”
But your mama wey use groundnut money send you and your 4 siblings go school from primary school till university level innocent Abi???? Girl wey dey do crochets to survive na Ash@wo but your mama wey dey roast corn to feed you and your 6 siblings, pay una school fees from Primary school till university level na SUPER WOMAN.
Mind you, that time Groundnut na N20, Roasted corn na N50.
And he ask,I told him were I work and I see myself through school and I pay my bills, he is like are you sure or na man dey sponsor you, really.
You wey ur papa die leave you and siblings with your mama make she dey sell groundnut and banana,go ask your mama if she dey sure if na only that she dey sell sponsor you and your siblings to school?or another man dey wey your mama dey sponsor for knackademous and him dey sponsor una with cash.
Very soon, una go carry me go meet una mama make she tell me the kind groundnut wey she sell, and the kind corn wey she roast, wey make her fit sponsor 5 children go university single-handedly since when una papa d!e.