17/09/2022
π€£Warri Proverbs..π€£
""""""""""""""""""""""""""""""""""
*WARRI_PROVERBS*
π
1. Na person wey never see problem dey use English dey pray.
π
2. Book wey no gree enter head go enta exam hall .
π
3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.
π
4. Who naked no dey chuck hand for pocket...!
π
5. Wetin concern dog with family planning?..
π
6. Na determination dey make Okada overtake trailer for road.
π
7. This one good, this one good na im mad man take dey gather plenty load.
π
8. Pikin wey go strong go strong.... No be say until dem name am Samson.
π
9. Na over confidence make February no complete.
π
10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.
π
11. Head wey no wan think go carry load..
π
12. Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket.
π
13. Forget Trust If trust dey, Water nor for boil Fish.
π
16. No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile.
π
17. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start.
π
18. Feel at home, feel at home naim dey make visitor spoil remote .
π
19. Es**rt me, es**rt me naso slave trade take start.
π
20. It's a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.
π
21. Christianity is free, but you must buy Bible
π
22. Person no dey use shame chop winch o
π
23. Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.
π
24. You no need spoon and cutlery to chop slap.
π
25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.
π
26. The patient dog, nah hungry go kill am.
π
27. Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds.
π
28. No food for lazy man no be for pesin wey im mama get restaurant.
π
29. Who dey owe landlord rent no dey fry stew wey curry dey.
π
30. I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooh
Good evening guys