01/08/2026
Delta State govnor, Sheriff Oborevwori give two million naira grant each to families wey return from South Africa sake of xenophobic attacks.
Di south-South govnor also announce monthly stipend of N200,000 for individuals and N300,000 for families wey return, until di end of im first term as govnor.
Dem go begin receive di monthly stipend from August, 2026.
Di package also include free medical screening for all health facilities wey di state get as e tell all Deltans to receive dem wit compassion and support.
Nigeria and South Africa still dey put leg for one trouser sake of businesses and pipo wey kpai during di anti-migration protests and attacks wey force pipo to return home.